Home News Lockdown news today in Nigeria: 'Covid-19 third wave never worst reach to consider lockdown' – Nigeria government – BBC
News

Lockdown news today in Nigeria: 'Covid-19 third wave never worst reach to consider lockdown' – Nigeria government – BBC

Share
Lockdown news today in Nigeria: 'Covid-19 third wave never worst reach to consider lockdown' – Nigeria government – BBC
Share

Wia dis foto come from, Muhammadu Buhari FACEBOOK
Nigeria President Muhammadu Buhari bin ease lockdown for some state for di kontri for May 4, 2020
Wit di sharp increase in di spread of di Delta variant of Covid-19 for Nigeria, authorities for di kontri don come out to tok say dem no dey consider anoda lockdown.
For some days now, Nigeria don dey experience increased cases of Covid-19 infection.
On Wednesday, Nigeria Centre for Disease Control say di kontri now dey average more than 700 new cases – dia highest Covid-19 cases in six months as states dey struggle to stop di spread of di highly contagious Delta variant.
But Minister of Health, Dr Osagie Ehanire, tok on Thursday say di number of cases no dey threatening enough yet, for goment to consider lockdown.
Dr Ehanire confidence dey come for time wey Nigeria dey reason to begin second phase of vaccinations as dem don receive about 170,000 doses of Johnson and Johnson Vaccine on Thursday.
Nigeria President Muhammadu Buhari bin announce lockdown for March, 2020 to help reduce di spread of di virus.
Wia dis foto come from, Getty Images
On Monday August 3, di United States officially hand over four million doses of di Moderna Covid-19 vaccines to di Nigeria goment.
Dis donation dey significant as only one percent of Nigeria population don collect di vaccine according to National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA).
Dr Ehanire also tok say di goment don buy nearly 40 million doses of di Johnson and Johnson vaccine through di African Union
Executive Director of NPHCDA, Dr. Faisal Shuaib tok say di vaccine na for pipo wey dey " hard to reach" areas, like riverine communities wey no get accesses to Primary Health Care centres.
Di Health Minister also add say pipo wey don take di first shots of AstraZeneca vaccine go collect dia second doses by di end of August wen 3.9 million doses of di vaccine type go arrive Nigeria.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Share

Leave a comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Related Articles
PSC publishes timetable for 2026 senior police promotion exams
News

PSC publishes timetable for 2026 senior police promotion exams

The Police Service Commission has released the timetable for its 2026 promotion...

Police recover 28 human skulls from Isuochi forests in Abia
News

Police recover 28 human skulls from Isuochi forests in Abia

The Abia State Police Command recovered 28 human skulls and bones from...

The municipal council gate and clock tower at the city entrance in Kano, Nigeria.
News

Suspected rabid dog bites 18 people in Garko, Kano

The Nigerian Forest Security Service, Kano State Command, says a dog suspected...

Kubwa Expressway road with vehicles and nearby buildings in Kubwa, Abuja
News

Vehicle crashes into gas outlet, explosion damages nine shops in Kubwa

Vehicle crash into gas outlet triggers explosion in Kubwa An early-morning crash...