Home News World ASUU strike update 2020: Goment say Academic Staff Union of University 'dia demands dey unreasonable' – BBC
World

ASUU strike update 2020: Goment say Academic Staff Union of University 'dia demands dey unreasonable' – BBC

Share
ASUU strike update 2020: Goment say Academic Staff Union of University 'dia demands dey unreasonable' – BBC
Share

Wia dis foto come from, ASUU/TWITTER
Di Federal Ministry of Education for Nigeria don tok say di demands wey di Academic Staff Union of University (ASUU) dey give dem before dem call of dia strike dey unreasonable.
ASUU bin tok say dem neva call off dia strike because dem dey wait for goment to do integrity test ontop di University Transparency and Accountability Solution (UTAS).
Tori pipo Punch say ASUU President, Prof. Biodun Ogunyemi tok for interview say goment need to give di clearance to National Information Technology Development Agency to conduct integrity test on UTAS.
UTAS na payment platform wey ASUU create afta dem reject goment payment platform – Integrated Payroll and Personnel Information System (IPPIS).
But di tok-tok pesin of di Federal Ministry of Education, Ben Gooong tell BBC Pidgin say ASUU no suppose dey choose how goment go pay dia staff salary.
"I no know whether you sabi how many groups, organisations and associations dey receive salary from di federation account. So if evribodi do dia own payment platform, imagine how many payment platforms goment go dey deal wit", oga Gooong tok.
Whether goment don accept UTAS or not, ASUU presido Prof. Biodun Ogunyemi say, "We still dey follow dem tok, we don given dem di position of our members, we feel say we go fit hold meeting dis week if dem neva change plans."
Ogunyemi explain say ASUU dey ready to resume academic activities if goment ready to play dia part.
Wia dis foto come from, AFP
ASUU dey disagree with di goment on top di use of di IPPIS. Di joinbodi tok say dem no fit register for IPPIS as di payroll application no go fit work for some special activities of im members.
Di union National President Biodun Ogunyemi say di IPPIS operators dey short change members salaries.
ASUU come develop im own payroll application, wey dem call the University Transparency and Accountability Solution (UTAS) and tell goment say na only dis application dem go gree use.
Apart from di IPPIS and salary matter, di joinbodi also dey hold goment to honour di agreement wey di two parties agree for 2013, wey dem finalize again for February 2019.
Di issues for di memorandum of understanding na on top lecturers welfare and proper funding of universities for Nigeria.
But early dis month, Federal Goment agree to pay N30bn to ASUU.
ASUU start nationwide strike on Monday 23 March, 2020 till further notice to call goment attention to di demands wey dem don dey ask since.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Share

Leave a comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Related Articles
11 women found dead in Ekurhuleni over 10 weeks, police say
World

11 women found dead in Ekurhuleni over 10 weeks, police say

South African police said on Sunday that 11 women have been found...

Emblem of South African Police Service
World

Two mass shootings in South Africa leave 27 dead

Two mass shootings in South Africa leave 27 dead Two separate mass...

Latest update on ASUU strike today Sunday, 12 June 2022 – Idoma Voice Newspaper
World

Latest update on ASUU strike today Sunday, 12 June 2022 – Idoma Voice Newspaper

The Academic Staff Union of Universities (ASUU), announced that present negotiations with...

ASUU strike will affect your victory in 2023 – Primate Ayodele warns APC – Daily Post Nigeria
World

ASUU strike will affect your victory in 2023 – Primate Ayodele warns APC – Daily Post Nigeria

Court dissolves Bauchi State University ASUU leadership, orders fresh electionStop running to...